Hot topics close

Ivory Coast vs DR Congo highlight Sebastian Haller goal lead Cote ...

Ivory Coast vs DR Congo highlight Sebastian Haller goal lead Cote
Host Ivory Coast na one of di best losers but now dem don reach final of di 2023 Afcon.
Afcon 2023

Wia dis foto come from,

7 February 2024

New Informate 9 hours wey don pass

Host Ivory Coast beat DR Congo 1-0 to reach di final of di ongoing 2023 Africa Cup of Nations.

Sebastien Haller score di only goal for di 65th minute afta dem play goalless for first half.

DR Congo get beta chances but dem no take am wey lead to dia exit from di tournament.

Di match wey get plenty action from di first half see host Ivory Coast dey press DR Congo until di final whistle.

Host Ivory Coast na one of di best losers but now dem don reach final of di 2023 Afcon.

Dis victory setup a Group A rematch between Nigeria and Ivory Coast on Sunday.

Meanwhile, DR Congo and South Africa go face each oda for di third place match.

Second Half

Sebastian Haller celebrate Ivory Coast goal

Wia dis foto come from,

Full Time: Ivory Coast 1-0 DR Congo

90+6 Referee blow whistle match don end.

90+3' Simon Banza of DR Congo) drills one effort from di edge of di box but e go over di bar.

90+1' Ivory Coast quickly take di corner kick wit a short pass.

90+1' Lazare Amani of Ivory Coast do on a solo run, but im fail to create a chance as di opposition player block am. Di referee and im assistant point to di corner flag.

90' Referee add 5 minutes

90'Max Gradel too don comot Jeremie Boga don enta.

90' Substitution for Ivory Coast. Sebastien Haller wey score di goal don comot and Jean-Philippe Krasso replace am.

89' Gedeon Kalulu of D.R. Congo whip di ball inside, but e fail to reach any of im teammates as di opposition defence clear di threat.

86' Silas of DR Congo commit one yeye foul in order to win di ball from im opponent. Mutaz Ibrahim blow im whistle.

84' Max Gradel of Ivory Coast bring im opponent down. Mutaz Ibrahim blow whistle for foul.

84' Lazare Amani of Ivory Coast try one pot shot from di edge of di box, but e narrowly go wide of di left post.

82' Max Gradel of Ivory Coast fall down sake of one challenge for di box, but di Referee no listen to all di appeals from all players.

80' Substitution for Ivory Coast. Simon Adingra don play finish Jonathan Bamba enta for am.

79' Max Gradel of Ivory Coast strike di ball towards goal, but it fail to reach di target afta defenders block am.

78' Substitution for DR Congo. Silas don enta for Meschack Elia.

78' Meschack Elia of D.R. Congo strike a shot towards goal from di edge of di penalty box, but e fly go wide of di left post.

73' D.R. Congo no take advantage of di corner as di opposition defence clear di ball.

73' Theo Bongonda of DR Congo try to find im teammate wit a pass from outside di box, but di opposition defence clear di attack. DR get corner kick.

71' Sebastien Haller of Ivory Coast smash di ball towards goal from di edge of di penalty box, but im effort flies just a few inches wide of di right post.

Fiston Mayele don enta for Yoane Wissa.

69' Substitution for DR Congo. Charles Pickel don comot Aaron Tshibola don enta.

65' Ivory Coast 1-0 DR Congo

65' GOAL! Sebastien Haller of Ivory Coast scores wit beta shot into di roof of di net afta Max Gradel give am beta pass.

61' Seko Fofana don comot Ibrahim Sangare don enta.

61' Substitution for Ivory Coast. Jean Michael Seri comot pitch and Lazare Amani replace am

61' Max Gradel of Ivory Coast react well to get to the rebound im take shot from di edge of di box, but im fails to get di ball to di players wey dey stand between him and di goal.

60' Max Gradel of Ivory Coast put one cross into di box as im bin dey try to find one of im teammates, but di defence manage to clear di ball. Ivory Coast get throw-in.

59' Quick shot wey Franck Kessie of Ivory Coast take from mid-range towards di middle of di goal land for goalkeeper Lionel Mpasi-Nzau hand wey bn no dey to ready but im manage to recover and save di ball.

58' Sebastien Haller of Ivory Coast commits foul afta e try to kolect ball from im opponent.

57' Wilfried Singo of Ivory Coast try to dribble past DR Congo player. Di ball go out of play. Ivory Coast get throw-in.

56' Cedric Bakambu of DR Congo make one serious challenge and Mutaz Ibrahim blow whistle for foul.

52' Yoane Wissa of DR Congo do one bad challenge. Di referee sees am and immediately blows im whistle.

50' Ghislain Konan of Ivory Coast pass di ball into di box, sent by Ghislain but DR Congo defenders block am.

49' Ivory Coast player dey find am hard to near Theo Bongonda of DR Congo, wey finally take shot inside di box. Di effort bin look like say e go enta di box but e go wide to di right post.

48' Di defence dey alert for dis match wey get plenti action, dem clear one dangerous cross from Meschack Elia of DR Congo.

46'DR Congo bin make one attempt but na offside.

46' Substitution for DR Congo, Sebastien Desabre don comot and Theo Bongonda replace am.

46' Second half don start afta Referee blow whistle.

First Half

DR Congo and Ivory Coast

Wia dis foto come from,

45+4 First Half don end

45 ' Referee add 3 minutes.

44' Seko Fofana of Ivory Coast carelessly pass ball give im opponent. Mutaz Ibrahim blows for foul.

43' Chance! Franck Kessie of Ivory Coast grab one short pass just by di edge of di box e fire shot. Di attempt beat di goalkeeper but comes back off di left post.

40' Wilfried Singo swings di cross over. Sebastien Haller of Ivory Coast head am but it goes just wide of di right post.

40' Simon Adingra of Ivory Coast cross from di free kick no get weight at all as one of di defenders clears am witout stress.

39' Cedric Bakambu of DR Congo kolect warning sake of say e hold di ball. Freekick for Ivory Coast.

38' Wilfried Singo of Ivory Coast send one pass into di box, but dem clear im attempt.

36' Sebastien Haller of Ivory Coast find space inside DI box to shoot afta e kolect short pass, but ie fly over di bar.

35' Dem clear di corner kick, notin come out.

34' Simon Adingra of Ivory Coast break free, but DR Congo player clear di ball. Ivory Coast get corner kick.

34' Arthur Masuaku of DR Congo sends anoda beta cross from di corner kick. but di Ivory Coast defence no dey give dem space, dem clear di ball.

33' Meschack Elia of DR Congo sends one beta cross into di area, but Yahia Fofana stop di ball.

32' Sebastien Haller of Ivory Coast don commit small foul to stop di attacking move of im opponent referee don warn am.

29' Yoane Wissa of DR Congo grab one loose ball wey im play inside di box. E fire shot sharp sharp towards di bottom left corner, but Yahia Fofana save am.

26' Meschack Elia of DR Congo pass into di box no dey successful sake of say players cut am.

25' Notin come out from di DR Congo corner kick as Ivory Coast clear am witout any problem.

24' Cedric Bakambu of DR Congo play beta shot wey target goal from inside di area, but Ivory Coast defenders block am. DR Congo get corner kick.

22' Cedric Bakambu of DR Congo bring down Ivory Coast player and Referee Mutaz Ibrahim blow foul.

20' Gael Kakuta of DR Congo fly from corner of di area towards di bottom right corner, but Yahia Fofana save to di ball.

18' See Chance! Wilfried Singo send one beta curling cross into di middle of di defence and near wia Simon Adingra of Ivory Coast dey. E head di ball from di centre but e go wide for di right post.

16' Ivory Coast get chance to score from di corner kick, but dem clear di ball.

16' Simon Adingra of Ivory Coast troway beta chance as im pass di ball into di box but defenders block am. Ivory Coast get corner kick.

15' Gedeon Kalulu of DR Congo sends one high cross into di box but dem head am comot.

13' Willy Boly of Cote d'Ivoire bring im opponent down wit a tackle and Mutaz Ibrahim blows im whistle for foul.

10' Referee say NO GOAL! afta e see foul wey Cedric Bakambu of DR Congo commit.

8' Cote d'Ivoire clear di corner kick and notin come out from am.

8' DR Congo get corner kick afta Meshack Eli break away from di post, e carry di ball run beat Cote d'Ivoire players but at last dem block am.

4' Charles Pickel of DR Congo use too much power try to collect ball from im opponent Referee Mutaz Ibrahim blows for foul.

1' Wilfried Singo of Ivory Coast produces one dangerous cross into di box wey DR Congo player block.

1min: KICK OFF

Ivory Coast

Wia dis foto come from,

Line Ups

Cote d'Ivoire starting 11: Yahia Fofona, N'clomande Konan, Jen Seri, Wilfried Singo, Seko Fofana, Franck Kessie, Wily Boly, Max Gradel, Evan Ndicka, Sebastien Haller, Simon Adingra.

DR Congo starting 11: Lionel Nzau, Hencock Baka, Samuel Moutoussamy, Meshack Lina, Gael Mambenga, Cedric Bakambu, Charles Monginda, Yoane Wissa, Chancel Mbemba, Gedeon Kyatengwa,Fuka Arthur Kawela

Similar news
News Archive
  • Permian Basin
    Permian Basin
    Plains expects 2023 Permian oil output up by as much as 500000 bpd
    10 Feb 2023
    9
  • Bra
    Bra
    Jockey Women's Forever Fit Supersoft Modal V-Neck Molded Cup Bra L Grey Seed, v neck molded cup
    17 Apr 2024
    1
  • Pontus Jansson
    Pontus Jansson
    Pontus Jansson backs up Swedish claims of Leeds United selling due to FFP issues
    9 Jul 2019
    11
  • Rock
    Rock
    ‘Grave challenge’: Blackpool rock makers fear for seaside staple’s future
    24 Apr 2024
    1
  • Deji vs Alex Wassabi
    Deji vs Alex Wassabi
    Deji Vs Alex Wassabi: Fan Storms Into Ring And Is Chucked Over Top Rope In WWE Royal Rumble Style
    5 Mar 2022
    8
  • Unisex public toilet
    Unisex public toilet
    'Superbugs' found on floors, ceilings and door handle of hospital toilets
    1 May 2024
    8
This week's most popular news