Hot topics close

China earthquake: Death toll rise to 126 for Tibet earthquake BBC ...

China earthquake Death toll rise to 126 for Tibet earthquake BBC
Authorities confam say at least 126 pipo die for di earthquake so far.

Wia dis foto come from, Reuters

Article information
  • Author, Laura Bicker & Koh Ewe
  • Role, BBC News
  • Reporting from Beijing and Singapore
  • 7 January 2025, 11:38 WAT

    New Informate 2 hours wey don pass

At least 126 pipo na im authorities comfam say don die and 188 odas wunjure afta one major earthquake strike di mountain region of Tibet on Tuesday morning, Chinese state media say.

Rescue workers dey search for survivors afta one major earthquake kill dozens of pipo and damage more dan 1,000 buildings for one remote region of Tibet, near Everest.

Di earthquake wey hit Tibet holy Shigatse city around 9am local time (01:00 GMT) bin get magnitude of 7.1 and deep reach 10 kilometres (six miles), according to data from US Geological Survey, wey also show several aftershocks for di area.

Neighbouring kontri of Nepal and parts of India also feel di tremors.

Earthquakes dey common for di region, wey dey on top one major geological fault line but Tuesday own na one of China deadliest in recent years.

Shigatse na one of di holiest cities of Tibet. Na di traditional seat of di Panchen Lama, one of di main pipo for Tibet Buddhism. Na only di Dalai Lama spiritual authority pass im own.

China bin disappear Tibetan Gedhun Choekyi Niyima wey dem identify as di reincarnated Panchen Lama, wen im bin dey only six years old.

Di current Dalai Lama run from Tibet go India for 1959 and since den, Tibet pipo dey see am as alternative source of power as dem no like Beijing control of di region at all.

Many pipo believe say China go also chose im own Dalai Lama when di current one die.

Tuesday earthquake na one of di deadliest wey China don see in recent years.

Videos wey China state broadcaster CCTV bin publish show collapse building and houses wey destroy, as rescue workers dey move around dey give area pipo blanket.

Temperatures for Tingri county, near di location wey di earthquake hit pass, dey around -8C (17.6F), and e go still drop to -18 dis evening, according to China Meteorological Administration.

Both light and water for di region dey affect.

Dem no support media player for your device
Play video, "Moment powerful earthquake strikes China's Tibet region", Duration 0,4200:42

Tingri county wey sidon for di bottom of Mount Everest, Tingri county na popular base for climbers wey dey prepare climb to di tallest point of di world.

Everest sightseeing tours for Tingri, bin originally planned for Tuesday morning, but dem cancel am one tourism staff tell local tori pipo, come add say di sightseeing area also dey fully closed.

Three visitors bin dey di sightseeing area but dem don move dem to go one outdoor area for safety, dem say.

Sangji Dangzhi - wey dem damage im supermarket in di earthquake - tok say di damage to homes dey extensive.

"Here di houses na from mud so wen di earthquake come... lots of house collapse," di 34-year-old tell news agency AFP by phone, adding say ambulances don dey take pipo to hospital through out diday.

One hotel resident for Shigatse tell Chinese media outlet Fengmian News say na di earthquake shaking wave wake am from sleep. E say said e grab im socks and rush out to di street, wia e see helicopters circling above.

"It feel like even di bed dey lifted," e tok, adding say immediately know say na becos of di earthquake wey Tibet dey experience.

Dem don cut out both power and water in di region. More dan 40 aftershock hsppun hours afta di quake.

Wia dis foto come from,

Chinese state media report say di earthquake bin get slightly lesser magnitude of 6.8, causing "obvious" tremors and leading to damage of more dan 1,000 houses.

Jiang Haikun, na researcher for China Earthquake Networks Centre, tell CCTV say while anoda earthquake of around magnitude 5 fit still occur, "di possibility of bigger earthquake dey low".

Since Tibet try to gain full independence from China way back for 1911 Revolution afta di collapse of di Qing dynasty, Chinese authorities keep di autonomous region under tight control, including im media and internet access.

One hotel resident for Shigatse tell Chinese media outlet Fengmian News say im jump up from sleep.

Im say im grab im socks and rush out enta street, wia im see helicopters dey circle above.

"E bin feel like say e bin even lift di bed join," im tok, come add say im sharply understand say dis na earthquake because Tibet recently experience multiple smaller quakes.

Wia dis foto come from,

Di Chinese air force don launch rescue efforts and drones to di affected area.

Chinese president Xi Jinping don also call for all-out search and rescue efforts to minimise casualties and resettle affected residents.

Although Nepal bin feel strong tremor, dem no report any major damage or casualties, one official from di National Emergency Operations Centre tell BBC Newsday - only "minor damages and cracks on houses".

Di region, wey dey near one major fault line of di Indian and Eurasian tectonic plates, na home to frequent seismic activity.

For 2015, one 7.8 magnitude earthquake near Kathmandu, capital of Nepal, kill nearly 9,000 people and wunjure over 20,000.

Di tremors on Tuesday morning, wey push many pipo for Kathmandu run comot from dia houses, bring back memories of dat deadly disaster.

"For 2015, wen di earthquake hit, I bin no even fit move," Manju Neupane, wey be shop owner for Kathmandu, tell BBC Nepali. "Today di situation no dey scary like dat. But, I dey fear say anoda major earthquake still fit hit us and we go dey trapped between tall buildings."

Another thing we de for inside dis tori

Similar news
News Archive
  • Matt Le Tissier
    Matt Le Tissier
    Matt Le Tissier 'steps aside' from Southampton role after backlash over Ukraine tweet
    6 Apr 2022
    14
  • ATP Finals
    ATP Finals
    Dominic Thiem beats Stefanos Tsitsipas in low-key opening of ATP Finals
    15 Nov 2020
    5
  • NASDAQCNTY
    NASDAQ:CNTY
    Century Casinos, Inc. (CNTY) Sinks 4.43%, Brings Too Much Of A Surprise
    22 Jun 2019
    1
  • WWE Hell in a Cell 2019
    WWE Hell in a Cell 2019
    WWE Hell in a Cell 2019 results: Seth Rollins retains Universal Championship after bizarre finish
    7 Oct 2019
    7
  • Gallium arsenide
    Gallium arsenide
    Global Gallium Arsenide Wafer Market Data Analysis 2019-2025 – AWSC, GCS, WIN Semiconductors, AXT, Century ...
    22 Oct 2019
    2
  • Scarlett Jenkinson
    Scarlett Jenkinson
    Brianna Ghey's killer Scarlett Jenkinson's family breaks silence as ...
    2 Feb 2024
    4
This week's most popular news