Hot topics close

Authorities teach Nigerians how to avoid scammers wey promise UK ...

Authorities teach Nigerians how to avoid scammers wey promise UK
Di UK for memo list out di level scams wey dem don find wey target foreign students.

Wia dis foto come from,

12 February 2025, 12:50 WAT

New Informate 58 minutes wey don pass

Di British High Commission to Nigeria don draw ear give kontri pipo say make dem dey careful of school and work scams if dem dey plan Japa go di United Kingdom.

Dem tok dis one for one statement even as Universities for di UK don dey torchlight scams wey dem dey make give foreign students since 2024.

Di UK for memo list out di level scams wey dem don find say dey directed as foreign students.

Dis na as ova di years, tori don dey comot about di sharing of worthless visas and work offers most especially for care homes wey no dey for di UK.

E don leave plenti pipo to dey stranded for di kontri as dem dey carry dia full savings to take attend di schools or go take di job.

Di warning tok say make you start to fear if di work or study route get guarantee visa offer.

Dem also say if di offer say you go get quicker and easier entry to enta UK pass official methods.

Dis na as for September 2024, BBC investigation find out global network wey chop thousands of pounds from students say dem go find dem work as care workers.

One of dem sell 141 visa documents and most of dem bin dey useless.

Some of di women wey give dis pipo money for work wey no dey say dem now don hook for UK becos if dem go back house e mean say dia family money don waste be dat.

Skip Twitter post
Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Accept and kontinu
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Twitter post

Scams wey di UK goment don sabi

Wia dis foto come from,

Websites wey dey give jobs for UK wey no dey

If pesin apply inside one of dis sites, dem go tell you say you don get di job and ask di pesin make dem pay for di visa and work permit fees.

No be so di visa systems for UK dey work. Real employers go send you go di goment website so you go officially apply.

Pesin wey go pretend say dem be officer for Home office or from visa application centre

If pesin come your house to ask money make dem run your partner visa, run.

Wetin dey happun be say legit visa officers go meet you for office and no go ask you for money in pesin, either by call or by email.

Di only way wey dem go fit call you na if wahala dey wit your visa. Dis scammers dem dey mainly torchlight pipo for inside UK and most especially students.

Pipo wey dey target applicants for UK work or study visas

Di scammers go ask di potential victim make dem give di scammers money to prove say you fit support yourself for di UK.

Wetin dey happun be say, as part of di official application process, you must to submit proof say you fit support yourself but nobodi suppose ask you for money.

Agents wey claim say dem dey work for Home Office or visa application centres

Dis agents say dem fit get visa wit forged documents.

Fake agents fit also tok say dem fit speed di process to get visa nad fit ask for payment wit Tunes voucher or personal bank accounts make dem rush di visa application process.

Tips on wetin to do if you get work or study offer from UK

  • Check di goment Register of Worker and Temporary Worker licensed sponsors to check weda di company dey real and weda dem fit sponsor you
  • Check for spelling errors dey di offer or di company website
  • Check goment guidance page for common fraud, tricks and scams
Similar news
News Archive
  • Angers vs Arsenal
    Angers vs Arsenal
    Arsenal: Gunners beat Angers on penalties in penultimate pre-season friendly
    31 Jul 2019
    4
  • Iranian
    Iranian
    How Iranian cyber ops pivoted to target Israel after 7 October attacks
    6 Feb 2024
    7
  • No Mans Sky
    No Man's Sky
    No Man's Sky lead Sean Murray celebrates a 1% improvement in Steam reviews because each point is just that much ...
    9 Apr 2024
    21
This week's most popular news